Search Site: OnlineNigeria

Close
Dis Subsidy Sef

Posted by Public Information Project Management on 10/27/2011 4:58:21 AM |

Written by: Public Information Project Management



We dey hearam for morning,


For afternoon sef we dey hearam,


We dey hearam for night.





Dem dey halaram,


We no dey rest.





Subsidy!


Subsidy!!


Subsidy!!!


Dis subsidy sef.





Dem say na awuf money


Wey we dey chop,


Dem say na government money.





Awuf money we no see,


Government we no see,


Na so so suffer we dey.





Kidnappers dey kidnap us,


Thieves dey thief our property,


Militants dey murder us,


Better things we no dey see.





Upon dat,


Dem still dey hala subsidy,


Dis subsidy sef.