Search Site: OnlineNigeria

Close
Security Shakara For Lagos

Posted by Public Information Project Management on 10/27/2011 4:57:16 AM |

Written by: Public Information Project Management



Boko Haram dey for North


Dey bomb,


Dey harass.


MEND dey for Niger Delta


Dey maja.


MASSOB  dey for East


Dey maintain.


OPC dey for West


Dey operate.


Militants full everywhere


Dey maintain levels.


Security dey shake shake


Dey find shelter.





Independence day waka dey come,


Abuja come get as e be.





But Presido must collect salute,


Him must deliver speech,


Long long speech,


Madam sef must wear heavy headtie.





But Presido no wan hear


Say dem shoot bird,


Di pickin fly away.





Dat day come come,


Dem comot property


For inside Presido parlour,


Dem call soldier and police,


Dem parade, Presido collect salute,


Madam headtie dey hala,


Presido deliver long long speech.





As independence day pass,


One newspaper for Lagos write something,


Security come dey show working,


Security shakara come full Lagos.