Search Site: OnlineNigeria

Close
EFCC Gragra

Posted by Public Information Project Management on 10/27/2011 4:55:43 AM |

Written by: Public Information Project Management


Like Johnny Walker
Dem go waka dey find vote,
Dem go waka go north,
Dem go waka go south,
Lie lie promise
Na im full dem mouth.


For election day
Dem go carry thugs,
Dem go carry dem rig di election.


As dem enter government,
Abracadabra  don start,
Talk talk
No better action don start.


Dem go carry plenty plenty people
Wey no get wetin to do,
Dem go carry dem full office.


Na so money go dey waka,
Na so money go dey vanish
Dey enter dem pockets.
Na so so travel travel,
Na so so jolly jolly,
Dem office come dey inside aeroplane.


For another election,
Other wayo politicians
Wey dem mouth sweet pass,
Wey get thugs pass
Go rig dem comot,
Dem go run go oversea.


When dem don hide
Di money wey dem thief finish,
Dem go show for Naija,
Dat time EFCC gragra go start.


Dem go arrest dem,
Dem go use yeye evidence
Carry dem go court.
Court go give dem bail,
Matter don finish.