Search Site: OnlineNigeria

Close
2020 Na Di Year

Posted by Public Information Project Management on 10/27/2011 4:54:20 AM |

Written by: Public Information Project Management



Warehouses


Don turn to worship houses.


Companies don waka,


Churches,


Mosques


Na dem dey now,


Everybody now na prayer warrior.





You need water


You go borehole go buy.


You need security


You go police go pay.


If you need light


You buy generator.


Petrol nko?


You buy from black market.





Every day,


Every day


Dem dey yan say


2020 na di year.


Na di year


Wey light go shine well well,


Wey water go flow everywhere,


Milk and honey sef go flow.





2020 wey dey run dey come so,


Wey be like tomorrow


Na im be di year


Wey every every go boku,


Wey better life


Go yafu yafu for Naija.


So we siddon dey look,


Dey listen to this kin yan.