Search Site: OnlineNigeria

Close
WAHALA DEY

Posted by Chovwe Inisiagho-Ogbe on 11/23/2009 2:49:49 PM |

Written by: Chovwe Inisiagho-Ogbe


Trouble dey  for Naija



The government  just dey sleep

People just   dey cry

Na so so darkness

From NEPA to  Powerholding

New wine wey nor change

Poorman  go ever suffer

Yes ooo wahala dey borku!

 

The   government  just dey stubborn

People just dey wonder

All  roads  get potholes

From Lagos to Benin

The Ogas  na to fly

No need to make repairs

Yes ooo wahala dey yafunyafun !

 

The government just dey jolly

People nor fit chop

Food don become gold

Person nor fit go market

Upon all the vote

And the fake promises

Yes ooo wahala  dey well well !

 

The government nor dey shake body

People  nor go hospital

Doctor  don finish

Not to talk of medecine

Dem nor go school sef

Pikins  hardly learn

Yes ooo wahala dey multiple!